
Who go fit put asunder take commot or divide the love wey Christ get for us? Abi na tribulation or na discomfort wey dem dey call distress or na grief, wey be say the world go put orishirishi gbege for our head wey dem dey call persecution abi na food wey person no go dey see chop at all at all wey dem dey call famine abi na to dey waka up and down sake of say we no get clothes to wear wey dem dey call nakedness abi na danger wey we dey face yafuyafu for our life wey dem dey call peril or na the weapon wey devil dey use torment us?
All these things no near, no reach, no even pass the kind love wey baba God get for us.
As dem don take write for baba God book sey na because of us wey im been suffer everi everi to make sure sey we free from sin and for the end time we go be like person wey go dey answerable to all the sins wey we don commit.
For inside all these suffer suffer wey im don go through because of us we go come pass all the kurukere waka & katakata things wey the devil don plan to take harm us, join with the brekete love wey Christ get for us.